Di minister explain say "di investigation show say Oga Kwarteng wey dem employ on 11 August 2017, bin create unauthorized link for di embassy website wey bin dey divert visa and passport applications to im private company, Ghana Travel Consultants (GTC), wia im dey charge extra moni for plenty services." Apart from dis IT officer wey dem don sack wit immediate effect, di foreign ministry also don take oda actions against staff wey dey work for di Ghana embassy for Washington DC. Di minister tok say dis actions go cause some pressure for pipo wey wan apply for visa and passport during dis period.
CONTINUE READING